| In 
                        an interview with Nneka O. Paj keeps it real with NE and 
                        gives us insight on what its like to be in his shoes NE: 
                        PaJ Eskwaya, how are you doing today?Pa J: I full ground boku...
 
 NE: Tell us a little more about the man behind the 
                        music.
 Pa J: Well...Pa J na very simple guy na...born 
                        in Lagos with Ibadan parentage but with a flair for anything 
                        Naija. Attended Mayflower School, Ikenne, Nigeria. Had 
                        a brief stint @  Yaba College of Tech before heading 
                        to Yanki. I love my Amala fluffy, my goat tender and my 
                        palmwine fresh. Avid follower of the Naija Super Eagles 
                        and no dey find wahala unless yanga come tap me...
 NE: 
                        I am curious, where did the name PaJ come from?Pa J: I been waka go intanet na im I make detour 
                        go one Naija website...I come dey see people dey use 'foneh' 
                        names wey I no sabi pronounce...so…I borro small leaf 
                        from the comedians from way back and gi my online persona 
                        a razz name: Alagba Jeremaya. But na im one my friend, 
                        Mallam Kongi, come vex after a while sey Alagba Jeremaya 
                        too long for am to dey type, sey shey I fit shorten am 
                        to "Pa J or sontin"..I sey 'ok'...and na so the name stick 
                        Alagba means elder statesman (like pesin wey sabi efritin..or 
                        @ least tink sey E sabi:) and Jeremaya is obviously mispelled…intentionally 
                        though…this was all before I begin do music..
 
 NE: How did it all begin?
 Pa J: Well...the idea been start for 2001 when 
                        I wan go do sontin for the NRC Reunion in NYC...normally 
                        I dey follo dem do small participation for anything wey 
                        dem organize so after two years for Reunion na im I sey 
                        make I troway dem somtin diffren…U know? So I enter studio 
                        with three tracks (comedic stuff) but as I dey enter na 
                        im the music mind wey  I no sabi sey I get before 
                        sef follo me enter...I enter wiff three tracks and comot 
                        with ten (many of the songs were written while waiting 
                        for the studio guy to begin warm the machine we go take 
                        record) a few weeks later...and since then songs just 
                        dey tap me for shoulder sey make I sing dem.
 
 NE: Where do your musical inspirations come from?
 Pa J: Everything...personal experience, sontin 
                        wey I notice wey don happen to anoda pesin, the depth 
                        of Naija culture and what makes us unique, stuff wey dey 
                        happen around me, and some na just fictititous stuff clawed 
                        out of thin air...things wey we both hold sacred and ignore 
                        in life…U know…those minor details people no dey pay attention 
                        to: if U waka roll yansh pass me now I go describe am 
                        in detail  for song!
 
 NE: What is a typical day like for you?
 Pa J: Weekday: Gym, Work, Traffic (na then I dey 
                        spend quality time orchestrating my moves artistically), 
                        business and family calls and rest.
 Weekends: 
                        Gym, Business Meetings, Studio, family time (na every 
                        Sunday I dey go raid my sister fridge), soccer (either 
                        watched or played), guest appearances, stage performances 
                        and occasional kpan- never mind dat part.
  
 NE: 
                        You perform a lot. What would you say is the best part 
                        about performing?Pa J: The best part is when U get a feeling sey 
                        people dey appreciate who U are and ya music. Like Sting 
                        talk am…Music is its own reward...so when everything is 
                        going right and U can look insai the eye of ya crowd, 
                        and can tell sey no be sey dem dey fake the funk...ya 
                        day good. Maybe someday dem too go know sey no be only 
                        Fuji artists dey appreciate 'spraying' though.
 
 NE: We absolutely loved your first album and the 
                        2 mixtapes but I’m sure a lot of people would like to 
                        know when to expect the second album.
 Pa J: God Willing 2006...I hate to say that becos 
                        E don tey wey the first album comot but it takes a lot 
                        to make this happen...when I drop the first one I no sabi 
                        nada..na like NIKE:  JUST DO AM! I no set table like 
                        Promotion, Management and other strings wey U need to 
                        pull to make it get to the masses...I record am, E sweet 
                        me…I drop am! But the next one no go be like so...right 
                        now we dey work on promoting that ‘Unleashed’ album via 
                        music videos and promo packages for Naija...once dat moto 
                        begin run well well, I go enter studio go begin record 
                        the next one.
 
 NE: What makes it different from your first album, “Paj 
                        Unleashed”?
 Pa J: Well...E go get the same approach…mixed vibes 
                        a la multi-genre stuff but this one go get some of wetin 
                        the first one no get: CLUB BANGERS! No be sey I dey crossover 
                        O! U will still get a VERY NIGERIAN style of music but 
                        the way wey we go cook am na to give U plenty variety...with  
                        a somewhat more commercial approach if I may. Some of 
                        the things people liked in the first one will still be 
                        there though...for instance I don pen encore for Matrimonial 
                        Palaver already and there are some singles in the works 
                        for your typical melodic African style, however...the 
                        reggae and dancehall part is deemed to be a lot different 
                        from the first album.
 
 NE: Are you satisfied with the level of support you’ve 
                        been getting or do you feel like there could be more?
 Pa J: Well...I do get some support from my peeps 
                        but honestly there could be more....and this no dey exclusive 
                        to Me. E get some things wey need to change for everyone 
                        in the Naija music scene to begin benefit in more ways...but 
                        changes dey come sha...I don dey see some things happening 
                        already amongst the movers and shakers in our society...some 
                        peeps like dem Ariztos Inc dem, dem Solitude dem, dem 
                        Chichi dem, dem Omoge Entertainment dem don dey pull strings 
                        wey go bring more awareness to wetin dey happen...and 
                        dat na just for Yanki...so...no shakin'.
 NE: How do you handle the occasional negativity?
 Pa J: ...of course naturally I go vex and skatta if 
                        pesin dey intentionally yan opaks with intent to denigrate 
                        and una sabi how my mouth be...however…with the recent 
                        developments wey don dey take place now dem kin' tings 
                        na  minor issue especially when I know sey na Baba 
                        God send me and no be pesin.
 
 NE: Any plans of breaking out into the music scene 
                        in Nigeria?
 Pa J: Of course! Haba...na home chop dey now!! 
                        God willing sometime by the end of this year sha...I go 
                        go introdoze masef to my people.
 
 NE: Who is hot and who is not? Name 3 Nigerian artists 
                        in each category
 Pa J: Chei! U wan make Areaboyz come jump me for 
                        MM Airport shey?? kai! Ok.. I like Maintain, I like 2face 
                        (who no like 2face music?) and Eldee of Trybesmen...and 
                        dat na for artists wey people don sabi well well…as for 
                        those wey dem go soon  sabi well I like Damask, Ronnie 
                        (the sweetest female voice in Naija music if U asked me!), 
                        and Rukus....as for those wey I no tink sey dem hot? hmmm...I 
                        like my knees the way dem dey so make I sharrap for dat 
                        one, by the way my pal Asha is also a voice to watch out 
                        for...in many ways.
 
 NE: What artists would you like to work with?
 Pa J: Wow! Well...Maintain comes to mind, Rukus 
                        comes to mind, Rappatainer comes to mind, and of course 
                        make U expect future more works between Pa J and Damask, 
                        a collab with Asha dey hide for the corner corner of my 
                        mind already...I fit work with anybody as long as we get 
                        musical chemistry. Now..outside Naija...it'd be nice to 
                        drop verses with my idol: Buju!
 
 NE: How do you feel about Kennis music?
 Pa J: U know...I never really paid Kennis Music 
                        much attention till I been see some music video compilations 
                        from Naija and I tell U…they're doing a really good job, 
                        especially  with 2Face. I, however, hope sey @ some 
                        point sha dem go begin spread wings and move things globally 
                        mainstream sha...with the right artists dem go be a major 
                        force in effecting the spread of Naija art everywhere.
 
 NE: What’s on your playlist right now?
 Pa J: Fuji Ropopo--Chief Kollington Ayinla
 
 NE: What are your short and long term goals?
 Pa J: Short term: Drop my next two albums and watch 
                        my people miliki from dusk to dawn. Long term: Play my 
                        part to spread Naija art globally...take the gift God 
                        has given me as far as I can..
 
 NE: Apart from your love of music, what else gets 
                        you going?
 Pa J: Soccer! I tell U...when Naija dey play and 
                        AIT dey show am here, my oga don know sey I no dey come 
                        work! And...just as an exclusive for NE...I don pen anthem 
                        for the Super Eagles. If only the yeye sports stores here 
                        go carry some Naija track suits maaaaan.....*mad*
 
 NE: Any plans for a future MaJ?
 Pa J: I dey take application...U wan try am? If 
                        U sabi roll yansh, no spill Palmwine when U pour am and 
                        ya stew no dey dey watery, U fit qualify!
 
 
 
 NE: 
                        Here’s a little rap I made upMy name is tina
 I come from argentina
 I eat sardines for dinner
 And I aint no sinner
 
 -I reckon I’ll make it in the industry. What do you think?
 Pa J:
 Chei!Ya Name No be Tina
 And U come from Katsina..
 Ya favorite na Semolina
 and na tief U tief ya Cortina!
 
 ..I see collab for awa future O!!! Well..if JLo still 
                        dey sing U sef fit make am!
 |